Lagos Dispatch Business Saga

avatar
(Edited)

How far na my Hive-Naijarians!

See eh, I just dey laugh my self as I dey make this post. Una don ever try to roll with the big boys and find yourself for oyo?

Omo street nor funny o. @estherscott post make me dey remember when my husband and I tried our hands on logistics business. I swear those dispatch boys use our eyes see pepper! The one wey pain me pass na person money wey dey invested. Money wey we take start up the business with three bikes for Lagos. We still dey the loan matter now. I for mention our logistics name but let's be calming down first because I still dey tell myself say the business never die. Say we still dey on hold, even though my husband don give up tey tey. I never really ready to let it go. So make I nor cast am yet.

Wetin come happen? Hahaha my country people, the thing choke. E choke!

Fresh married couple like my husband and I had a rough start financially in our marriage life just because of a business idea we thought was going to be a break through for us.
absolutvision-82TpEld0_e4-unsplash.jpgsource
But we were only just starting! And life had a surprise for us. We did our due diligence. We gave it our all. But we lost it.

Omo, na pidgin go sweet to tell this story. So if you nor sabi pidgin, nor vex.

As I was saying jarea. The idea start for lockdown mid 2020. Luckily for us we found good Samaritan-a family friend who loved the idea and was willing to invest. Na im our madam give us this money o. As per we don dey ready to swing into action long before the fund drop, we immediately kick off operations as the money land.
mika-baumeister-Hr3Z-f765QQ-unsplash.jpgsource

Mehn, we were sailing on sunshine at initial stage. As customers dey rush we come dey happy say money dey fall on us yanfu yanfu but not for long bro because 'village people'
send Dispatch boys. From entering Lagos state government fines, to entering agbero wahala down to destroying and stealing customers items. Abi make I start talking about how they outrageously started billing us with bike repairs right in the middle of an express delivery or disrupting multiple delivery route just to do their own side hustle.
john-onaeko-bPZgs6GNuvM-unsplash.jpgsource

Wo, we come dey fall sick and go thin. The usual cool, calm and collected me became hot blooded. Our blood hot soté e come dey dry. Omo, the best thing as at that point was to leave logistics business for who nor mind police case. We couldn't just deal.

Nor tell me say I for ask questions before jumping in o, cos we did. The only thing you can say is that we should have kept pushing to go pass that rite of passage which is compulsory for every start up business abi wetin you wan tell me? Oya I dey hear. Tell me for comment session ooo



0
0
0.000
13 comments
avatar

Any start up business in Nigeria is hard..It takes patience a lot of it and extra money to hold down a business in this country...

0
0
0.000
avatar

😂 God will bless my friend and my sister that told me about all these in 2020 when I was considering going into logistics. They warned me not to even try it, if not I will be writing the same story like you now. Sorry though, but as usual, “we move”!!!

0
0
0.000
avatar

Aaaaarrrhhh! Just know say that person sew seed for your life. God save you bro

0
0
0.000
avatar

Omo!! , mesef be use delivery riders one time to deliver my online products
Like you said the movement dey go Norma but e no tay way them dispatch riders dey ditch my delivery pending days
Customers go kan dey call say hafa my package na
Wahala go kan sup

Maddest be say delivery agent go still kan carry your product bounce

Wo! Logistics na big risk one kind o
What about way billing (wahala)
Sheybi na we one bam bam. 😂

Lagos and wahala

0
0
0.000
avatar

Ha! You been dey there too! Na we wan chill with them big boys ni o

0
0
0.000
avatar

😂😂😂😂 you saw shege. Maybe if you had persevered it could have gotten better like you mentioned.

0
0
0.000
avatar

Pele, Lagos will naturally do it’s best to frustrate new businesses. If you do decide to start again, do it with people you can actually trust.

0
0
0.000
avatar

Thanks. But the probability of pick off from where we left is very low.

0
0
0.000